Nigerian Superstar, Ayodeji Balogun wey pipo sabi well-well as Wizkid don dey cause confusion on top social media for some times now wit some of im posts.
Di one wey make pipo para pass na di one e drop dis weekend, wen e announce say im no be “Afrobeat artiste”.
Afrobeats na one genre of music dem dey majorly categorise many African music under.
For plenti Instagram story wey run into late Saturday night, di musician wey dey call im self Big Wiz bin originally write say, “Abeg if you like Pakurumo Wizkid no download dis music” come later add say “if you like afrobeats, no download my album”.
E add say “I no be afrobeats artiste, no call me dat. I no be Afro anytin.”
Dis na as im dey tease im new studio album, wey dem dey call Morayo. According to am, di album na complete package.
For di now deleted Instagram story, e reveal di full reason why e no wan dey linked to di music genre, Afrobeats.
Wizkid explain say, “Listen I be African but I dey make all kain music, fine Music. But I no wan make dem just pack dem put as afrobreats. E be like to say every American dey make rap. E dey stupid.”
E add say, “Na why no mata di kain ogbonge music wey we make weda na RnB or any oda genre, dem go nominate us inside one African category or di oda.
“I don make songs from different genres of music. Made in Lagos no be ‘afrobeats’ album. Na mix of different sounds. Real music.”
How dis Wizkid tok, affect pipo?
Following im post, thousands of pipo enta social media to hala on top di latest tori from di desk of Big Wiz imself.
While some pipo bin support im choice say e no wan dey for league of Afrobeats artiste, oda pipo call am out either for wetin e tok or how e take tok am.
Pipo also call out fans wey yab Burna Boy wen im try separate imself for di Afrobeats name inside one interview for 2022.
Howeva, some pipo still dey reason di artiste mental health on top say, e dey comot more and more to troway yab on top social media.
Dis article contain content wey Twitter provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di Twitter cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose ‘accept and continue’.
Warning: Di BBC no dey responsible for di content of external sites.
End of Twitter post, 1
Dis article contain content wey Twitter provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di Twitter cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose ‘accept and continue’.
Warning: Di BBC no dey responsible for di content of external sites.
End of Twitter post, 2
Dis article contain content wey Twitter provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di Twitter cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose ‘accept and continue’.
Warning: Di BBC no dey responsible for di content of external sites.
End of Twitter post, 3
Wizkid no be di first Nigerian artiste to distance imself from Afrobeat.
For 2022, Grammy Winner, Burna Boy do interview wia e hala say wetin e dey do na Afro-Fusion and say im no be no be Afrobeat musician.
For di interview, Burna Boy clear di air say di sound wey Fela bin pioneer sef na Afrobeat not Afrobeats, but pipo lump togeda most Nigerian music for Afrobeats.
Although, Davido no say e no be Afrobeats artiste, for interview wit TMZ, e reveal say im get some kain RnB hits for im discography and say Afrobeats na wetin dem use encompass all di music form Nigeria.
Anoda Nigerian star, Tems, also refuse to term her music as Afrobeats. She say, “for di world view, objectively, my music na Alternative Afro Soul and RnB”.
How International audience use music charts and Awards class Afrobeats
Wizkid worry about putting all brands of African music under Afrobeat no just comot from nowia.
For March 2022, Billboard wey be di music publication wey dey drop music charts every week introduce di “Billboard US Afrobeats Songs” chart.
And Wizkid, Burna Boy and Tems, all of whom categorize dia music say e no be Afrobeats still feature for inside.
Infact di pesin wey be number one for di charts as at di time wey dis tori dey comot na Tyla wey describe her type of music for her website as pop.
Dem bin also introduce two Afrobeats categories for 2023 wey Burna Boy win Best Afrobeats act and Rema carry di best Afrobeats song for im ogbonge hit, Calm Down.
For 2023, MTV add di Best Afrobeats as new category in August.
Wizkid win di first Best Afrobeats Artist for di 2022 American Music Awards.
Wetin come ginger di rise in popularity for Afrobeats?
You fit no believe am but di first Nigerian sound wey catch Grammy ear from di kontri gan-gan.
For 1983, King Sunny Ade wey be Juju musician go become di first Nigerian out of di kontri to collect nomination for Best World Music Album for im albu, Odu.
But back to di mata of Afrobeats, na Fela Anikulapo Kuti popularise di Afrobeat sound.
Fela brand of music bin dey more instrumental based and e bin dey use am to sing about wetin don scata for Nigeria back in di day.
Years later, di sound of Afrobeats start to dey become popular all ova Africa even enta London and start to dey enta into music awards listings all ova di world.
Dis push in di popularity of Afrobeats, bin get beta benefits for many sounds across di continent to get chance to thrive for di international market, howeva na wia di kasala to dey call all kain African music Afrobeats take start from.